…E Don Tey…

By: Ibe Chiemezie (MEX)

Level: 1

1 Star2 Stars3 Stars4 Stars5 Stars (1 votes, average: 5.00 out of 5)
Loading...

E don tey wey we don dey hear say e go better

Say dem go give us light, good road and water

E don tey wey dem don dey promise and fail

Dem steady dey nack us join cross with nail

“Make una Vote me every thing go dey all right”

Na so we gather vote, from morning reach night

But things still dey fall apart like knot wey no tight

When last we see water for tap? E don tey

When last we see fuel for motor? E don tey

Naijiria jagajaga, e don tey wey Idris sing am

Till today dem still never repair am

E don tey wen dem dey play us like chess

Dem siddon ontop our head dey mess

E don tey we mama dey cry

Papa dey vex sey pocket dry

E don tey wey we youths dey ask why

We gofament too dey yarn plenty lie

E don tey wen I start to write poem

About this Agbada men dem

E don tey wen i taya for the mata

But me no go rest until dem reason the mata!

Me I go still yarn

Like Eldee , me I go speak my mind

1 Star2 Stars3 Stars4 Stars5 Stars (1 votes, average: 5.00 out of 5)

Loading...

Ibe Chiemezie (a.k.a Mex Konceptz) is a doctor by day and a poet by night! He sees medicine and poetry as inseparable tools for human transformation.

 

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *